On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

“Stay Your Papa House Till You Marry” — Pastor Talk Don Scatter Table Online!

One Nigerian pastor don cause gbege for internet as e talk say any woman wey wan marry no suppose dey live alone, buy car or build house until man come marry am.

According to am, "If woman don too independent, men go run! Dem go fear say she no go submit."

But Nigerians no gree o!

People don chook mouth for social media:
"I’ve never heard so much nonsense in under 90secs before."
"
women have really seen shege in this country. Yet y’all still don’t want to marry liabilities!!"

Na the same old wahala — society still dey pressure women to pick between marriage and success.

But the real question be: Why woman no fit get both?


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C