On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Divorce Palava: Woman Want Husband to Swear for Shrine, Because Of Dia Property

Love sweet but sometimes love dey change taste, and dey bitter for the pipu wey dey enjoy am. Wetin dey come spoil belle pass na wey you see two pipu wey love dem self come dey do like say the other person na dia enemy.

The mata wey Cheche tok about for ontop #WomensCorner for #OgaMadamOffice na beta example of wey love taste don bitter. 

Cheche tok the story of woman wey she and her husband no dey see eye to eye again, dis one come make the husband wan divorce the wife. But the woman come say the condition for the divorce na say she go share everi-everi wey dem get from company, house, land, and other investment equal. 

This one make the man vex as eim yarn say the woman no help get all those things and those things dey eim name so eim no fit share am equal with eim wife.  


The woman come tok say if the man know say she no help am get any of those properties and investments no need to go to court, she say make dem just go shrine wey dey her village make him swear.

Now Cheche dey ask how dem go fit solve the mata becos  

 

More from Oga Madam Office

  • Police No Fit Arrest Person Wey Use Stream Farm - Mr. Eazi

    Video

    With one of the biggest songs wey dey social media right now, wey be "Patek" Mr Eazi, don ready to show una say una neva see anything at all. As eim don drop anoda one wey eim call See Something.

  • E take Yemi Alade 5 Years To Reply My DM - GUCHI

    Video

    Ugochi Lydia Onuoha, wey many pipu know as Guchi na Nigerian Afropop/ Afrobeat singer. And she be one of the young female artiste wey dey show say dem no come play for the music industry.

  • Why Naija Men No Dey Like Bring Dia Wife Abroad?

    Video

    Ontop #OgaMadamOfficeShow Cheche Smith tok about the tori of man wey tok say e beta wey your wife dey cheat on you for Naija than for you to carry am come abroad and she comes dey mess your life up.

  • The Music Industry For Ghana No Dey Invest Like Naija - CAMIDOH

    Video

    Raphael Camidoh Kofi Attachie, Ghanaian Afropop, R&B and Afrobeats songwriter and musician. Enta we #ChookMouthStudio to tok about eim new jam wey eim collabo with Mavin records Nigerian born singer and songwriter, Alexander Adelabu wey pipu know as Magixx.

  • Your Pastor No Be Psychologist!

    Video

    On 10th October, the world join bodi togeda to mark world mental health day. And this one na day wey the world dey come to shine light ontop the mata of mental health and why e dey important for everi bodi to take am serious.


Today's Weather

  • Lagos

    Thunder storm

    High: 30°C | Low: 25°C