On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Man Need Advise As Eim Dey Suspect Say Na Eim Pastor Get Eim Pikin.

Trust na one of the things wey dem dey add inside relationship wey dey make the relationship soup sweet. And wen trust for inside relationship don Kpafuka e dey be like calabash wey fall scatta for ground e no dey easy to gum am back again.

Ontop Night Jolly, Uzo table mata wey one listener send say eim need advice ontop. According to wetin eim tok, eim Pikin wey be boy look like eim Pastor for church, and people dey even use play-play tell am about the way eim son take look like dia pastor for church. 

Wetin come make the mata dey disturb am for mind na because of the closeness wey dey between eim wife and dia pastor, even the way the pastor wife dey always do face anytime wey the pastor and eim wife dey talk also dey make am think say may be something dey happen between dia two.

But eim fear now na say eim no wan go do DNA test wey e come be say, wetin eim dey think come be true. The man tell Uzo say eim no know how to handle this mata, so eim need advice for other listeners.

Shey you fit help this listener? Oya chook mouth for the comment section.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C