On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Minister dem for Presido Buhari Govt don dey resign

President Muhammadu Buhari don tell members of the Federal Executive Council (FEC) wey dey run for offices make dem resign before Monday the 16th of May, 2022.

Minister of information and Culture, Lai Mohammed, tok dis one Wednesday for Federal Executive Council meeting.

Di ministers wey e concern na Minister of Transportation, Rotimi Amaechi; Niger Delta Affairs, Godswill Akpabio; Labour and Employment, Chris Ngige; Science, Technology and Innovation, Ogbonnaya; State for Education, Emeka Nwajiuba; Petroleum (State), Timipre Sylva wey wan run for post of presido under APC.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C