On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

If No Be Subsidy You For Dey Pay 400 For Petrol - Marketers

My Naija pipu don dey feel the stress of full scarcity, as many petrol station no get the product to sell and the ones wey get dey increase the price.

Pipu wey dey sell the product don come out come yarn say, if no be subsidy wey dey, the lowest price wey Nigerian National Petroleum Company Limited, go fit sell the product to dem na 400 naira.

Dem come yarn say the reason wey make the line to buy fuel for petrol station be like where dem dey give free food. Na because NNPC wey suppose be the only pipu wey dey import fuel for Naija, dey find am hard to import the product because of the import charges wey too much. So dem dey put the extra cost for the head of Depot Owners wey come dey push the cost give  filling stations. The owners of filling station no won gree carry the cost so dem come add for the amount wey dem dey sell for dia station to customers.

Dollar self follow chook hand dey make the mata bad, because dem dey buy a tonne for $15 and the exchange na be N440 to N450, now exchange rate na N750 to N800. So the price suppose go up.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C