On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Why di Nigerian Professional Football League neva reach di top level till today.

Calvin Onwuka, di founder of aclsports.com ontop di Football Afrik Podcast with Sawadinho (MVP) and Timi (PCFR) dey table di mata wey concern di slow progress of NPFL.

Di state of NPFL today, na eim be di main talking point ontop di 5th episode of di pidgin podcast 'Football Afrik' with di sports journalists Sawadinho and Timi and guest, Calvin Onwuka wey be di founder of aclsports.com.

Ontop dis level, Calvin Onwuka dey first of all establish di fact say even back in di days, nigerian Football teams no bin dey too too shine for continent, say even when Enyimba bin show doings for early 2000's say di strategy wey dem use no bin dey sustainable.

Sawadinho, di host of di podcast dey tok say Nigerian league get beta players but how Nigerians and di world at large go take watch dem be di problem because di league no dey TV at di moment.

Also, branding and packaging be one of di main areas wey Timi dey stress wey di league suppose focus on.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C