On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

Summer 2021 Football Transfers Round-up

All di major transfers wey bin happen for di Summer 2021 transfer window

From Messi transfer to PSG to Saul Niguez loan to Chelsea, plenty shocking transfers bin happen and as di window don close, make we look back at di major football transfers for summer 2021.

 

SERGIO AGUERO

(Free - Manchester City to Barcelona)

Aguero wey be Manchester City all time top scorer bin waka go Barcelona on free transfer as him new club dey hope say him go fit still perform.

 

DAVID ALABA

(Free - Bayern Munich to Real Madrid)

Dis transfer bin prove important sake of say Real Madrid bin lose their best defenders over di years in di persons of Ramos and Varane. Alaba no be learner for defence matter as him be sabinus and him don win all di major titles inside Germany and for Europe.

 

CRISTIANO RONALDO

(€15 million - Juventus to Manchester United)

Ronaldo second coming to Manchester United shock everybody. With everything wey him don achieve for him career, him return go surely ginja dem United players to kolobi every trophy possible.

 

ANTOINE GRIEZMANN

(Loan - Barcelona to Atletico Madrid)

Dis na one of the most one-sided transfers dis season sake of say Atletico be title contender and last season Suarez bin prove vital for Atletico title winning campaign. Di €10 million kpogri wey Barça go collect fit help dem financially dis season but because Griezmann bin cost €120 million, di loss margin dey too big.

 

JACK GREALISH

(£100m  - Aston Villa to Manchester City)

Di kpogri wey City cari buy Grealish plenty. Na him performance for him new club go justify or cancel am. 

 

MEMPHIS DEPAY

(Free - Lyon to Barcelona)

After him ogbonge performance for di Ligue 1 side, him compatriot, Koeman di Barça coach get plans to make di most of di Dutch player as Barça don lose some key players for attack.

 

SERGIO RAMOS

(Free - Real Madrid to PSG)

Di 35 year old player don win every possible cup during him time with Real Madrid and with di Spanish national team. No doubts say him go improve di overall quality of di PSG team and maybe give dem di much needed ginja to kolobi UCL trophy.

 

SAUL NIGUEZ

(Loan - Atletico Madrid to Chelsea)

After him title winning season with Atletico Madrid, di bros decide say di best place for him dis season na Chelsea. With dis kind player, Tuchel get more depth for midfield which fit helep Kanté injury concerns.

 

RAPHAEL VARANE

(€41 million - Real Madrid to Manchester United)

Varane dey join United to complete the missing piece for inside di defence. World Cup and multiple champions league winner, Ole go enjoy him presence if him go fit use am well.

 

GIANLUIGI DONNARUMMA 

(Free - AC Milan to PSG)

Undoubtedly di best young goal keeper right now in di game, di Euro 2020 winner be one of di best signings dis season wey don come Ligue 1.

 

OLIVIER GIROUD

(€1 million - Chelsea to AC Milan)

AC Milan sabi make di most from ageing players as we don see over di years. Giroud wey dey come from winning UCL wit him former club go try live up to expectations for him new club.

 

LIONEL MESSI

(Free - Barcelona to PSG)

For di beginning of 2021, if pesin bin tok say Messi go commot from Barcelona, most football fans no for believe. PSG don manage to land di biggest transfer of dis summer and him dey very obvious say na UCL be di club main target dis season.

 

ROMELU LUKAKU

(€115 million - Inter Milan to Chelsea)

Inter financial issues make dem give Chelsea dia best player for last season wey dem win the Scudetto. As Chelsea no bin fit get Haaland, Lukaku go prove to be a major force for dia campaign dis year.

 

JADON SANCHO

(€85 million - Borussia Dortmund to Manchester United)

United obviously dey plan kolobi di EPL title dis season as dem don land top notch signings dis season and Sancho be one of dem. 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C