On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Liverpool owners wan sell di club

Liverpool owners Fenway Sports Group don tok say dem dey open to 'new shareholders' as tori wey dey ground be say we fit see new ownership for di Merseyside football club.

Fenway Sports Group (FSG) bin buy Liverpool for 2010 and from dat time up till today, The Reds don win their first EPL title, Champions league, FIFA World Club cup and other domestic trophies with Jurgen Klopp as manager.

FSG bin also build modern training centre for di club wey cost millions of dollars.

As plenty rumours bin full ground, FSG release statement through The Athletic say, dem don receive offers from pipu wey wan be stakeholders tey tey no be today and if every every concerning any offer dey alright say dem fit consider new shareholders.

For di statement wey dem release, FSG don also tok say no mata wetin happen, di interest of Liverpool on or off di field be di koko.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C