On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - 10:30pm

FIFA U-17 Women's World Cup - Nigeria Flamingos to play Columbia for semi-final

Nigeria go dey look to enter final for di first time in di history of dis competition

Nigeria go play Columbia for di semi-final of di FIFA U-17 Women's World Cup and ontop dis level, dis go be di first time wey di 2 teams dey enter semi-final.

USA wey bin enter di quarter-final match against Nigeria as favourites bin lose on penalties after normal time.

For dis level of football, Nigeria go dey look to continue di 100% record against Columbia as dem bin win di South Americans twice before now.

Di semi-final match go shele by 12 noon (Nigerian Time) for inside Pandit Jawaharlal Nehru Stadium, India.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 27°C