On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Drama as pesin run enta pitch for World Cup match between Portugal and Uruguay

One football fan bin run enta pitch with rainbow flag for di match wey Portugal bin play against Uruguay for Lusail Iconic Stadium

Di incidence bin happen few minutes just before Bruno Fernandes bin give Portugal di lead against di South Americans.

Di pitch invader bin wear t-shirt wey carry message of solidarity for Iranian women and di war wey dey happen inside Ukraine.

FIFA don already make am clear say dem no go tolerate any public display of support for LGBTQ or any controversial issue wey go disrespect di values of Qatar pipu dem.

Security officials bin cari di invader comot from stadium as di match wey Portugal later win bin continue immediately.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C