On Air Now

Club Wazobia

10:30pm - 1:00am

Bournemouth don sack di manager wey carry dem come EPL

Scott Parker na di first manager wey don chop sacking for EPL 2022/2023 season

Bournemouth don sack Scott Parker after Liverpool knack dem 9-0 for Anfield.

Dis tori bin come as a shocker as di club make di announcement for their official website on Tuesday Morning.

Until Bournemouth get another manager, na Gary O’Neil, di ex-midfielder go stand in as coach.

No be new tori say Parker don lose him last 3 EPL games but if you really check dis mata, e be like di sacking dey too soon.

From Manchester City at Etihad, to Arsenal wey don win all their matches and finally Liverpool at Anfield, wey get very strong attack, Bournemouth, di fixtures wey Bournemouth don play so far no be beans. On di good side, dem score Aston Villa two goals while keeping clean sheet and dem win their EFL game away against Norwich. Bournemouth no even dey relegation zone yet as Everton, Wolves and Leicester dey rock di relegation zone.

Dis positives anyway no still dey enough for Bournemouth management as dem don sack Parker. Maybe na di 9-0 knacking wey Liverpool give dem cause di sacking. 

For dis level, Parker no be di first manager wey don collect wotowoto. Southampton manager Ralph Hasenhüttl don collect 9-0 back to back: 2019/20 against Leicester for eim own dormot and 2019/20 against Manchester United 2020/2021. On top all dis trashing, Southampton no bin sack am.

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C