Morocco don beat Nigeria on penalties to book their place for the AFCON 2025 final, after di semi-final end goalless for full-time and extra time.
Di match end 0-0, but for penalty shootout, Morocco win 4-2.
Penalty Result:
-
Morocco: 4
✅ El Aynaoui
❌ Igamane (saved)
✅ Ben Seghir
✅ Hakimi
✅ En-Nesyri -
Nigeria: 2
✅ Paul Onuachu
❌ Chukwueze (saved)
✅ Fisayo Dele-Bashiru
❌ Onyemaechi (saved)
Morocco goalkeeper, Yassine Bounou, na di hero again as e save two Nigerian penalties. After dat, substitute Youssef En-Nesyri come score di final kick wey seal di win for di hosts.
With dis result, Morocco don qualify for Sunday AFCON final, where dem go face Senegal. Senegal reach di final after dem beat Egypt for di first semi-final, with Sadio Mané leading di charge.
Na heartbreak for Nigeria, but Morocco move on as dem dey eye di AFCON trophy for home soil.