On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Bukola Saraki Claim Say Inflation Rate No Reach Double Digit Under PDP

Claim: The inflation rate today na around 16% but under di government of Peoples Democratic Party (PDP) na single figure e be .

Verdict: NA LIE

Under the PDP government, the kontri inflation rate dey go up and down between single and double figure and presently na 21.34% according to CBN December 2022 report. 

 

Full Tori

Politicians especially candidate dem for dis 2023 general elections for Nigeria been don dey tok to voters since di join body of Independent National Electoral Commission (INEC), open the campaign window for September 2022. 

For di national level, especially among di presidential candidate dem, di campaign don become very hot for di candidates and dia team dey do plenty things to prove say na dem be di correct party so dem fit get di votes of pipo dem.

For January 16, 2023, one  member for the Peoples Democratic Party (PDP) presidential campaign council, Bukola Saraki , been dey for Arise TV, and inside the interview, im claim say  di inflation rate today na around 16% but, under the PDP, na single figure e dey. Him tok dis one between 4:18 minutes to 4:25 minutes inside the video

 

Background

The Peoples Democratic Party, PDP, na di main opposition political party for Nigeria  and na dem power between 1999 and 2015. 

The party dey follow  drag chair for dis 2023 election wey dey kom for front as dem don dey do since 1999. 

Former vice president Atiku Abubakar (1999-2003) na di flag man for di party this time, just as im do for di 2019 general election. 

Bukola Saraki  na  two-term governor for Kwara State and di senate president for Nigeria from 2015 to 2019. 

Di  All Progressive Congress, APC, don dey rule since 2015, with Muhammadu Buhari as the president. 

 

Verification

Data from di Central bank of Nigeria, (CBN) don show di inflation rate for Nigeria from 1999 to 2022. 

 

Year 

Inflation rate (%)

1999

6.6

2000

6.9

2001

18.9

2002

12.9

2003

23.8

2004

10

2005

11.6

2006

8.5

2007

6.6

2008

15.1

2009

13.9

2010

11.8

2011

10.3

2012

12

2013

8

2014

8

2015

9.55

2016

18.55

2017

15.37

2018

11.44

2019

11.98

2020

15.75

2021

15.63

2022

21.34

Table wey dey show di inflation rate for Nigeria from 1999 to 2022

 


Chart wey dey show di inflation rate from 1999 - 2022

 

Di table and chart wey dey up so, show the inflation rate for Nigeria and na only 1999, 2000, 2006, 2007, 2013, 2014 to 2015 e show single figure. For di other years dem, na double figure e be.

Di data follow show say di years wey be single figure na under the PDP government except for 2015 wey APC  complete.

And e dey clear from di data say apart from 2015 wey be first year of APC, the ruling party no record any single digit up till 2022 wey we dey check. 

Although, we nor fit tok weda  Saraki been dey tok about where him party do am reach before dem kari power give APC for 2015. Di  inflation rate for 2014 na 8 per cent and 9.55 per cent for 2015 wey mean say PDP hand over one single-figure inflation to APC. 

Anyway, e dey clear say di APC government never fit  keep di inflation rate for single figure after 2015 wey dem collect power from  PDP. But di highest inflation rate wey be 23.8% for di history of di country na for 2003 and na for under di PDP government.

 

Conclusion 

Our search show say di inflation rate under di 16-year of PDP no dey only single figure and di rate wey e dey now (as of January 2023) no be 16 per cent as Bukola Saraki dey claim.  Di  rate right now na 21.34 per cent as at December 2022 and that figure still small pass the level of 23.8 percent wey e dey for 2003.   

 

 

 

 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C