On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

You Agree Say Tinubu and Atiku No Fit Solve Naija Problem?

Mata for 2023 general election don hot and most of the aspirant don dey hustle to solve the maths of how dem go take win the election.

Ontop #EveningOyoyo the host #Expensive come dey chook eye ontop the one wey Chairman of the Northern Elders Forum, Prof. Ango Abdullahi.

Pro. Ango tok say the presidential aspirants of both All Progressive Congress and Peoples Democratic Party wey be Asiwaju Bola Ahmed Tinubu and Alhaji Atiku Abubakar no go fit solve the problem wey naija dey inside.

Eim also yarn say the two aspirants don dey inside politics for over 30 years and dem neva fit change anything for the country. The Prof. tok dem no get the material wey go make Naija beta.

On top this tok naim make Expensive come dey ask wey pipu agree with the talk wey Oga Ango yarn

Some pipu wey call expensive yarn say wey Prof. Ango yarn na true e be, and if dem win Nigeria case na sorry sorry, other pipu call to still yarn ontop the mata.

Oya watch video to see the full mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C