On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

With BVAS Machine Politicians No Go Fit Rig Again - Olusegun Agbaje ( Lagos INEC REC)

The Independent National Electoral Commission don begin post the election voters register for the different electoral wards wey dey inside obodo Naija, so that pipu go help dey chook eye ontop am to see if dia informate inside dey Kajad.

This one na to make sure voters no go complain say dia name or face to show for election day. 

The INEC oga wey dey inside Lagos, Resident Electoral Commissioner (REC), Mr. Olusegun Agbaje. Come let Lagos pipu know say make dem come out go check the voters register wey dem don put for the  245 wards for the state.

Oga Agbaje come tok ontop #EveningOyoyo show with Expensive and Solid AC for Wazobia FM, say this one na opportunate for pipu to check the register and tell dem if dem get any complain or dem see person wey don die, abi na small pikin ontop the register.

Dem say dem don start this one for the wards since Nov. 12, and dem go stop  Nov. 18. The waka go come continue after Nov 18 for INEC local government offices from Nov.19 to Nov. 25. 

Expensive ask Oga Agbaje about the mata of pipu wey dey buy  PVC's. The Lagos Resident Electoral Commissioner (REC). Tok say with BVAS to rig election no fit happen again. And anybody wey plan do this one just dey deceive dem self.

"If anybody tell you say make you sell your PVC, make you tell dem say you never collect am, if not you no go fit vote for election day if you sell am".

Eim still say The commission don dey ginger, to make sure vote buying go stop. 

"2018 we tell pipu say after accreditation before you go fit collect ballot paper you must drop your telephone or any photographic equipment so that dem no fit carry am go the polling booth".  

Oga Agbaje come to say dem also want make judiciary join dem for this dia ginger, so as dem dey arrest pipu wey dey chook hand for vote buying or oda election mago mago, make shaperly judge dia mata.

"We dey ask National Assembly make dem give INEC the power to fit arrange mobile court wey go dey chook eye ontop mata of pipu wey dem catch for election day. Just like dem dey do for countries like Kenya."

So for pipu wey never check dia name for the register wey INEC don post for dia ward, Oga Agbaja tell dem say make dem try help INEC go check for dia name and informate for the register wey dem don post for dia.

Watch the siddon tok with the Lagos, Resident Electoral Commissioner (REC), Mr Olusegun Agbaje.
 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 27°C