On Air Now

Market Runz

11:00am - Noon

Why Nigerian Youths No Wan Join Nigerian Police ?

The public relations officer, of the Nigerian Police Force. Oga Frank Mba don come out com tok say the plenty young pipu for inside the south part of Nigeria no wan gree join police.

Oga Mba, shout this one wen eim dey annouce say dem to increase the time for the online registration to tak join police on friday.  eim come tok say out of the 81,005 applications wey dem get nationwide, only 1,404 come from the five states wey dey for South-East. And only 261 come from Lagos.

This one come make Expensive and Solid Ac, dey ask ontop #EveningOyoyo why many Nigerian youths no wan join the Nigerian police force. shey na because the money no dey police work or na because the work no sweet.

Watch the full video and Tell us wetin you think about the matter #ChookMouth . 

 


Today's Weather

  • Lagos

    Light rain

    High: 33°C | Low: 26°C