On Air Now

Sundae Jolli

6:00am - 10:00am

Why Igbo men dey struggle for politics – Pete Edochie

Veteran Nollywood actor, Pete Edochie, don cause kasala with one strong talk wey e yarn about Igbo politicians, say dem no too sabi play Nigerian politics well.

For one recent interview with Afia TV, Edochie talk say di average Igbo man no get di kind mind wey politics need, because politics dey involve small “betrayal” and strategic compromise.

“In fact, Igbo man no be better politician. Make I tell you why: people wey dey used to politics or di wahala wey follow am fit overlook many things. But Igbo man no dey built to forgive betrayal two times,” na wetin Edochie talk be that.

E still add say, once dem betray Igbo man, e no go gree forgive or work with dat person again, and na dis kain thing dey spoil long-term political relationships for am.

“If you do Igbo man strong thing once for politics, im no go gree make you do am again. E go just withdraw. Na so average Igbo man be,” Edochie talk.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 29°C | Low: 23°C