On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

#Ojota2012Protest: Why Pipu Wey Lead Am Close Mouth Now Wey Tins Hard?

The power to fit protest dey very important for any democracy, because naso beta goverment dey take know if the pipu wey dem dey lead, dey happy with the way dem dey run tins.

For inside we obodo Naija we don see pipu come out plenty time to show say belle no sweet dem, the way wey tins dey go for the country. January 2012, this type of waka happen. And we see plenti pipu come out to chook mouth shout about the wey corruption take dey press the country for neck, plus the goverment wan commot money wey dem dey add to make petroleum product cheap.

The Protest wey be #OccupyNigeria happen for Gani Fawehinmi park, Ojota. See big, big pipu, like Yinka and Joe Odumakin, Wole Soyinka, Femi and Seun Kuti, and Pastor Tunde Bakare. All of dem and even more follow come out to shout say dem no go gree. And make the goverment fight to kill corruption, not subsidy.

Ontop #EveningOyoyo Expensive and SolidAc. come dey look as things dey for inside the country, wey price of food don dey tie wrapper, and price of petroleum product don carry ladder dey climb go up, and Naira and Dollar no wan take eye see dem self. 

This one make dem dey ask shey the protest change anything? And why pipu wey stand for fronot during the protest, dey close mouth like say things never red pass as e dey for 2012? 

All this na the questions wey dem ask ontop dia show. The question even make plenti pipu start to call and send message ontop the mata.

One of the callers wey say eim  name na Brother Paul from Egbeda area for inside Lagos. Tok say "many pipu wey, been dey shout say make former presido, Goodluck Ebele Jonathan. commot for office been dey tok am because of dia own selfish interest."   

Eim even tok say, " Bag of rice wey eim being dey buy for 2012 for six thousand naira, to reach around 30 something thousand naira. light wey no dey don dey make even bank no fit work the way dem suppose dey work". 

Another listener  wey eim Twitter handle na @IzuImporter tok say. "No mata how we protest reach, politician go still do wetin".  All the complain come make Expensive dey ask. How market, shey things never hard reach, before we go speak out? tell am wetin you thing about the mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C