38 minutes | Thursday, 31 July 2025
You don ever hear story where person survive marriage wey dem force on am? The kain marriage wey come with wahala, beating, and demons full the other person body?
Abi you sabi woman wey dem tag as ‘too stubborn’ — say she no go ever be good wife so dem just marry her off to anybody? If you don witness or pass through this kain thing, this episode na for you.
We dey talk forced marriage, toxic partners, and how people dey survive when love no even dey the matter at all. Chook ear, e go heavy. #chookmouth