18 minutes | Monday, 4 August 2025
This Evening for Oyoyo, we chook mouth for the serious matter wey dey happen for Rivers State. You hear say one EFCC operative kpai because dem go invade lawyer house for midnight? With all the insecurity wey full Naija, e still shock people.
Last week Friday, one woman yarn for interview say EFCC break enter their area around 3am — dem beat one innocent fashion designer, wey no be yahoo boy, just dey hustle clean."
Meanwhile, EFCC still dey defend themselves say na their work dem dey do. But the big question wey dey worry everybody be: if una fit raid civilians in the middle of the night, how come una no dey raid terrorists with the same energy.
Na this kind matter we carry come today make you chook ear, and chook mouth.