On Air Now

Music

1:00am - 6:00am

Why our Society No Like To Hear Divorce?

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

With the way news about domestic violence and gbege wey concern men and women for inside relationship take dey come out. E come be like say pipu no dey learn from the experience of oda pipu.

No be today #Cheche don dey shout say, you no need to wait until you die inside relationship wey no good. And no be sin if you waka commit for relationship wey no good. But she come notice say upon all the shout plenti pipu, especially women dey find am hard to commot.

Because of wetin pipu go tok. Dis one don make pipu siddon put for inside relationship wey fit kee dem. 

Naim make she come dey ask wey our society no dey like hear mata wey concern divorce. Wen woman tok say her relationship dey abusive, instead make pipu chook mouth tell her to waka commot fo the relationship, dem go dey tell her to pray make God change the man.

E com be like say society no like wey woman waka commot for relationship, even if e no good for her.  

Watch see wetin pipu get to tok on top the mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 35°C | Low: 27°C