On Air Now

Night Joli

Midnight - 4:00am

Why Mama Go Dey Bleach Dia Pikin Skin?

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Skin Bleaching no be new tin. most especially for inside western part of africa. World Health Organization (WHO) tok say 40% of African women dey use skin lightening or bleaching creams.

Nigeria carry first for African as 77% of women using skin bleaching products (cream and non-cream based) wen dem chook eye ontop how dem take dey buy this bleaching cream. Togo follow for back with  59%,  and 27% for Senegal and 25% for Mali. 

But anoda level don dey come for this mata of to dey use cream wey go change person color. Wetin we see wey dey rain for inside we obodo naija now. Na mama dem wey dey use bleaching cream for dia small, small pikin. 

This one naim make Cheche siddon with sabi pesin ontop skincare mata Zuwaira Ikharo Shuaib, she be the founder of Amalbotanicals. And she follow Cheche tok about wetin fit happen to pikin wey dem dey use this type of cream for.

Zuwaira tok say today use bleaching cream ontop small pikin bodi, fit cause big gbege for that pikin, part from say e dey spoil the skin of the pikin. E fit also make that pikin get cancer later for life. 

She come tok say mama dem wey get small pikin dem, need to dey use natural products for dia pikin dem. Products like shea butter wey we dey call Ori, mango oil, palm kernel oil, and coconut oil. All this natural oil dey beta for small pikin skin.

Cheche come ask Zuwaira, wetin go make mama wey suffer carry pikin come dey use wetin fit spoil the pikin body, dey rob am for body. She tell cheche say, many mama dem dey want make dia pikin dem get oyibo skin, because dem dey feel say e fine pass black skin,or e dey make pipu look say dia pikin dey healthy. 

Many pipu wey dey listen to the siddon tok ontop #HealthCorner for #OgaMadamOfficeshow, call and send message to confirm say this mata na something wey dey self don see, and dem like as cheche chook mouth for this mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Heavy rain shower

    High: 33°C | Low: 26°C