My 8years Old Pikin Introduce Me To Joeboy And Asake Song - General Pype

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Olayiwola Ibrahim Majekodunmi, wey many of us know as General Pype, after many years wey we no hear any new song from am. Enta we WazobiaFm studio to follow our Cheche Smith for inside #OgaMadamOffice tok about wetin make am dey on a low key.

The champion crooner, tell us say the reason wey make am, stay on the low plenti wella. From say eim been wan get more education and other family wahala. Na the family wahala gongo naim make am waka go yankee. 

General Pype say when eim been dey away from the industy, anytime wey eim post for social media people go dey tell am say make eim drop new song for dem.

But wetin dem no know na say even wen eim no dey drop new songs, e no mean say eim no dey record new songs. Eim just dey wait for everi everi to arrange wella for eim to dey drop am.

Cheche ask about wetin eim think about the new set of artist wey dey hold the industry for work now? Pype hail the way the new artist take the drop hits dis days and eim dey happy about the work wey dem dey do.

According to am eim say na eim 8 years old pikin naim introduce am to Joeboy and Asake music. And eim say Johnny Drill na genius and eim Music dey so out of the box.

General Pype say eim dey work on a new album and make we dey expect new jamz from am.  

 


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C