On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

How You Go Dey Count Noodles Because You No Want Wey Your Wife Over Eat?

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Wen two pipu do wedding, dem dey tok say two don become one. So you go wonder wetin go make pesin go marry anoda pesin and you go come dey do tight hand for dat pesin wey you and am suppose be one?

How you go put signature untop garri because you no want make your wife over eat. Shey no be wickedness be that or the pesin just wan manage eim resources?

Chechesmith talk about this mata untop women's corner for inside oga madam office, And shey ask why you go get partner come dey treat dem like that. Why you no just dey alone.

Plenti pipu wey follow her talk ontop the mata, talk say the mata na the reason why women need to hold dia sides, so that dem go avoid unneccessary insult like that.

Watch the video to see the full mata


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C