On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

How You Fit Handle Possesive Lover

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Many People dey relationship/marriage wey dey chook them, their partner dey monitor their evri move and question evri phone calls wey enter their phone. Oyibo dey call this one Obsession and e dey resemble true love for the beginning.

Jude meet one lady wey be banker and after 2 weeks of dating, him notice say the Lady dey monitor am, she dey suspect am, always dey check him phone and she go dey ask am who call am, she no dey let am go out. When Jude vex tok say him no dey do again, she enter Bathroom carry Razor cut her two wrist, start to dey bleed almost to death.

Thank God say him see her on time rush go Hospital. After she recover, she come back to him House, Jude don tire and dey plan to transfer to another state go work.

Na this Mata Chiboi and Adadumdum tok ontop #Trutalk inside #Kulelezone


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C