On Air Now

Club Wazobia

10:30pm - 1:00am

Why Your Birthday Na The Reason Your EX-still Neva Move On

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Mata wey concern breakup na situation wey wen e happen something pipu dey find am hard to move on. Some of them dey even come up with different tactics to take cope with the mata.

But for some pipu dem don try everi tactics wey dem sabi but still yet dem, the feeling wey dem get for dia ex-lover neva fit disappear. 

Even wen dem dey with other pipu, some of dem dey still refer to dia ex-lover for dia new relationship. Dis one naim make Uzo come decide say as she be relationship specialist and sex therapist make she find out why you still dey hard for pipu to move on from dia ex-lovers.

As she chook eye for the mata she come notice say the birthday of your ex-lover fit explain why e dey hard for you to move on. 

Uzo tok say for you pipu wey dia ex-lover dem born dem from Feb 19 - Mar 20. the reason why dia ex-lovers never move on, na because dem dey so romatic and you give dem the best sex wey dem don ever experience. 

So if you wan know why your ex-lover still ontop your mata, you go need to see the full video 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 27°C