Oyibo tok say respect Is reciprocal, meaning say as you want make pesin do for you na so make you do for the pesin self. How you go say you love pesin and the way wey you dey treat dem you self no go gree make dem do you so.
This one naim make Uzo come look am say e go good make she let dem this pipu wey go dey relationship come dey do dia partners anyhow, know say the thing wey dem dey do no good.
On top #BedroomTalk for inside #NightJolly. Uzo list different thing wey be say as wife, if your husband dey do am to you eim no get respect for you.
Some of the thing wey she list for the signs wey go show you say your partner dey disrespect you na, if your husband dey try to change you. She say dat one of the sign to show eim no respect you. Because if eim respect you, eim no need to dey try to change you, afterall eim see you before eim say make you and am dey collabo.
Uzo come talk say if man no respect you e dey show wen una dey make love. The way eim go dey handle you like say you no mata, make eim just do wetin eim want do.
Oya watch the video to see if you dey inside relationship wey your partner no respect you.
The mata of how long man suppose last when eim and woman the do touchlighting mata, e don be arguement wey don dey ground since 19 okokoro. And up till date we still neva gree say na so so amount of time dey okay for touchlighting.
A different stroke for a different folks, na wetin oyibo dey talk. Wetin one pesin fit do for eim relationship and nothing go happen, anoda pesin go do am an everitin go kpafuka.
Confidence inside bedroom dey important for sexual partners, because e dey help boost the morale of the couples dem. that na why you no suppose act or talk anyhow wey fit drop the confidence of your partner after sex.