E don tey wey sabi pipu don dey advise, say the best wey to prevent sexually transmitted disease and infection plus even pregnancy na to use condom.
According to UNAIDS and the National Agency for the Control of AIDS dem tok say about 1.9 million pipu for naija dey live with HIV. Dis statistics just cover just HIV, wey be just one type of STD(sexually transmitted disease) imagine how many more pipu for naija get other types of STI's.
That Na why dem they advise more young pipu, to do practice safe sex, if them no fit keep body. Condoms fit dey uncomfortable but dem dey guarranty protection from both STI's and Belle wey you not dey ready for.
But many pipu no gree say Condom no dey protect. Dis na why Uzomatic Uzo, talk about how, despite say condom good and e dey guarantee 98% protection from STI and Pregnancy. sometimes condom no fit protect you from some type of STI's.
She tok this one ontop #NightJolly, and she breakdown why condom no fit protect dem from some types of STI's. Watch to find Out why !
The mata of how long man suppose last when eim and woman the do touchlighting mata, e don be arguement wey don dey ground since 19 okokoro. And up till date we still neva gree say na so so amount of time dey okay for touchlighting.
A different stroke for a different folks, na wetin oyibo dey talk. Wetin one pesin fit do for eim relationship and nothing go happen, anoda pesin go do am an everitin go kpafuka.
Oyibo tok say respect Is reciprocal, meaning say as you want make pesin do for you na so make you do for the pesin self. How you go say you love pesin and the way wey you dey treat dem you self no go gree make dem do you so.
Confidence inside bedroom dey important for sexual partners, because e dey help boost the morale of the couples dem. that na why you no suppose act or talk anyhow wey fit drop the confidence of your partner after sex.