On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - 10:30pm

MKO Abiola Wife Don Drag IGP Go Court, Say Make Dem Pay Am N100billion

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Di wife of late Chief MKO Abiola, wey be Prof.Zainab Abiola don carry Nigeria Police Force (NPF) and Inspector-General of Police , Usman Baba go Federal High Court for Abuja say dem go pay her N100billion bcos say dem spoil her name.

Na her lawyer wey be Tawo Tawo (SAN), na im arrange di case wey di number be, FHA/ABJ/CS/2370/202 and e tok say, Zainab dey challenge police say dem spoil her name and dem no respect her right as human being.

For di report wey she give on Sunday, she tok say na one Ibrahim Alkali, wey be di pikin wey IGP adopt na im set her up for September 20, 2022, say she wound her former police guard wey be Inspector Teju Moses and dis news spoil her name no be small.

She tok say na, ''Ibrahim Alkali, na him plan with her former police gaurd to lie ontop her head say she wound her, she tok say she get CCTV Camera wey go show wetin happen true true when di court case start''.

She tok say, dem disgrace her, carry her go court, still spoil her name and since then, pipo don dey use bad eyes take dey look am. 

She still tok say, ''dis whole wahala cause plenty damage for her, e affect health and her level for di society don drop, even di good name wey she don build for di whole world, say she dey live her life for fear now''.

For dis reasons, she dey tell court say make dem order police pipo to pay her N100billion for all di damages, disgrace and wahala wey dem cause for her.

Di court case go start for 28 of February, 2023.

#chookmouth


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 33°C | Low: 27°C