FG don release N6.25 billion for cattle ranches for Katsinsa

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Katsina State Deputy Governor, Alhaji Mannir Yakubu, tok say Federal Government don release N6.25 billion sake of to build cattle ranches for Katsina.

Yakubu, wey also be Commissioner for Agriculture and Rural Development, tok dis one for di Ranch Stakeholders Development Meeting for Katsina on Monday. He tok say di areas wey dem go build the cattle ranch na  Jibia, Batsari, Dutsinma, Safana, Danmusa, Kankara, Faskari and Sabuwa Dandume nd odas

He also tok say prat of di N6.25 billion na to build schools, health center and animal clinics. He say Federal and State Government go ensure say peace go dey for areas wey bandits dey affect.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C