Dem Don Kill 39 Priest And Kidnap 30 Since 2012, Catholic Church Tok

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Dem don kill 39 catholic priests and kidnap 30 since 2012. 17 catechists and more dan 3,500 catholic pipo dem kill since 2012.

As dem dey do waka against de killin of Rev Isaac Achi wey bandits kill for Kafin-Koro for Minna, Niger State, de group tok say de attack don happen 47 time for catholic church for nigeria.

Di oga for(quarter for catholic and society) and executive Director, Caritas Nigeria, Rev. Fr. Uchechukwu Obodoechina, who carry oda go de press conference for Abuja, tok de killin of Achi, oda priest and Nigerians wey dey across de country.

Eim tok say "in fact dem don kill 39 catholic priests and kidnaped 30 tete for 2021, join, 17 catechists and catholic pipo wey fit pass 3500 dem kill for dat time.

"One come de tink and ask, wetin catholic church for Nigeria do dat make dem dey pass de rough and rude attacks?. I dey possible to reason say na plan to comot christainity and Christains for Niger?".

Obodoechina tok say Nigeria don become hell for earth, for dem dey waste and no value pipo live again.

"He tok join, say, pain and death don plenty dis days,single dey no fit pass make bad tori no show for  media and oda social media for one death rash or de oda.

"For wetin dem no fit say no dey happen, eim don be bad thing wey dey happen for better men and women for dis country, catholic priests and nuns, oda christians and muslims, de wik pipo, boko haram attack, pipo wey fulani herdsmen kidnaped, banditry and men and women wey dem shoot wey lost dia lives."

De cleric tok am wit good sence, say de attack on christain and especially priests for Niger for years wey don pass now, don make christians for Niger be pipo wey dey for danger.

#chook mouth#


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C