On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Court Don Free IPOB Leader Nnamdi Kanu

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The Court of Appeal for Abuja, Federal Capital Territory don chook eye for the case of the oga of IPOB, Nnamdi Kanu.

The court tok today wey be Thursday say the way wey dem take kolobi Oga Kanu from Kenya no follow both local and international law at all.

The Appeal court judge chook eye and mouth for the case, Justice Oludotun Adebola. Come tok say as federal government no fit yarn how dem take catch Kanu, e mean say dia case no hold water.

Justice Adebola come tok say on top the mata say Nnamdi Kanu dey free for everi-everi wey dey put for eim head for the case.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C