On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

Tinubu Don Postpone Im G20, AU-EU Waka Because of Tuesday Terrorist Wahala

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Naija President Bola Tinubu don postpone im waka to the G20 oga dem meeting for South Africa and im waka to the AU-EU meeting for Angola after all the gbege wey happen on Tuesday.

For Kebbi State, terrorist enter one school, carry many girls, kpai their vice principal. For Eruku wey dey Kwara State, dem enter one CAC church, shoot pipo anyhow.

President Tinubu suppose travel for those waka today, but now, im pipo for Aso rock don talk say Tinubu don pause the waka first, come order make dem find those terrorists wey attack that CAC church for Eruku. E even talk say make dem mount men the whole Ekiti Local Government Area for Kwara.

Chief town crier for Aso Rock, wey oyibo pipo dey call Presidency Spokesman, wey be Bayo Onanuga, talk say, “Our presido dey wait for his Vice President wey be Kashim Shettima, who im send go Kebbi State, make e run am update. Police and DSS for Kwara state suppose send am update too.”

Tinubu don come out to talk how the tin take pain am. E talk, “As the Commander-in-Chief of the Armed Forces, the soldiers wey die dey pain me seriously. I pray make God give Brigadier General Musa Uba family peace, and the family of other soldiers wey die

“The children wey dem carry for Kebbi dey really pain me. I don tell all our security pipo make dem pursue them, so that those girls go fit come back to their family dem, and so that dem go fit go back to school.”

Before Tinubu postpone this waka, Aso Rock don already dey plan how many pipo wan follow am go. Now, everything don dey on pause because presido dey wait make dem run am update unto the security mata.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 30°C | Low: 25°C