On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

SAPA Don Hold Nigeria Under APC - Atiku

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The person wey dey represent the Peoples Democratic Party for inside presido election, Atiku Abubakar. Don yarn say Nigeria pocket don dry for the hand of the All Progressives Congress.

Atiku tok say as e be like this Nigerian dey use boro boro make me rich take do our budget since APC enta power for 2015.

Na on tuesday eim tok this one when eim go follow people for Lagos Chamber of Commerce & Industry tok about wetin eim plan for Nigeria economy go be if eim win  2023 election.

Oga Atiku come still yarn say for the first time for Nigeria history, money wey we go use take pay gbese pass the one wey we dey make for the country. Wetin e show na say the government don fail to find solution to all the different wahala wey dey face Nigeria.

The PDP presido flag man come add say, Nigeria get power to fit double eim GDP by 2030. Because Nigeria suppose be part of the top 20 economies for obodo the world. 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C