On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Rivers Palliative Bus Don Park, Drivers Dey Suffer

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Dem bring di bus com out since June 1, 2020, when COVID lockdown choke everywhere...

Rivers COVID palliative bus, dem don park tire for RTC yard sai dem no dey carry person again. Dem tok  govrmint never drop money make dem run am, so di drivers don dey carry two months salary debt for head.

Dem bring di bus com out since June 1, 2020, when COVID lockdown choke everywhere, make people fit waka free and reduce di lockdown wahala. Later, dem continue di bus waka as transport fare begin dey craze.

One of di drivers don tok say di unpaid moni don put am for serious wahala, as e dey struggle to find food put for im family mouth.

Dis bus wahala come after Govnor Fubara don present di 2026 Rivers budget to di State House of Assembly more than one month ago, but dem never pass am. Nobodi never fit sai weda na di budget mata dey make govrmint hold di bus money.

But for normal Rivers govrmint workers, na different tori. Govnor Fubara still dey pay dem salary and dey push their promotion as e suppose be.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 29°C | Low: 24°C