Police don confirm say dem don kidnap Nasarawa State Commissioner

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
Police Command for Nasarawa State don confirm say dem don kidnap Nasarawa State Commissioner for Information, Culture, and Tourism, Yakubu Lawal.

Police Command for Nasarawa State don confirm say dem don kidnap Nasarawa State Commissioner for Information, Culture, and Tourism, Yakubu Lawal.

Police Public Relations Officer (PPRO), DSP Ramhan Nansel, confirm for statement on Tuesday for Lafia, di capital of di State.

“On Monday, August 15 for 8:45 pm,  Policemen for routine patrol tok say dem hear  gunshots for Nassarawa-Eggon Local Government Area of the state,” the statemen tok.

The PPRO tok say join bodi of Police Mobile Force, Anti kidnapping unit, Military pipo, Vigilante, and local hunters na dem burst enta di area where dem see gunmen enta di commiddioner house and kidnap am. 

He tok say dem don dey shine dia eye so dem go find am, and dem don drop phone numbers for pipo wey know where eim dey.

Di numbers na  08035951018, 08033806409, 08037461715, and 08036157659.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C