On Air Now

Our Backyard

9:00am - 11:00am

Peter Obi Don Promise N25m for School of Nursing and People Wey Dem Kill for Yelwata

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Nigeria Democratic Congress 2027 presidential candidate, Peter Obi, don promise N25 million to support education, health care and water projects during him visit to Benue State.

Obi Don Announce The Donations for X After Him Visit Makurdi, Gboko and Yelwata on Wednesday.

For Gboko, Obi first pay respect visit to Tor Tiv and meet with Catholic Bishop of Gboko, Most Rev. Father William Avenya.

Obi talk say him don promise another N10 million to support the running of College of Nursing Sciences wey the bishop establish. He also talk say him don dey support the school since dem start am.

He explain say investment for education and healthcare na important thing wey go help build Nigeria future.

The former governor also visit Yelwata, where he show support and sympathy to families wey the deadly attack affect.

Obi talk say him don pledge N5 million to help build borehole so people go fit get clean water. He also promise another N10 million to support the education of pikin dem wey lose their parents during the massacre.

He admit say the money no fit bring back the people wey dem kill or remove the pain wey the families dey feel, but e important to help the survivors get hope again and create better opportunities for dem.

He talk say, “No pikin suppose allow the tragedy wey affect their family decide wetin their future go be.”

Obi talk say dem end the visit with town hall meeting as part of him ongoing visits across the country.

Senator Rabiu Musa Kwankwaso, wey Obi describe as him elder brother and Nigeria Democratic Congress vice-presidential candidate, follow am go, together with other party candidates for Benue State.

Obi explain say the meetings na opportunity for political leaders to hear directly from the people and understand the challenges wey dem dey face for their communities.

He also thank Benue State Governor, Hyacinth Alia, say the governor personally return him call before the visit and assure am say dem go welcome am well.

According to Obi, the governor response show say humanity and respect suppose dey before political differences.

He repeat say Nigeria need to invest more for education, healthcare, security and human development. He add say people suppose judge leaders based on how their leadership take improve the lives of citizens.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Light rain

    High: 32°C | Low: 25°C