On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

Peter Obi, ADC Leaders Survive Attack for Benin

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

National Coordinator of Obidient Movement Worldwide, Yunusa Tanko, talk say dem attack leadership of African Democratic Congress (ADC) for Benin City on Tuesday, 24th February 2026, after one political event.

For statement , Yunusa Tanko say him and other ADC leaders comot from ADC Secretariat dey go house of party elder, Chief John Odigie-Oyegun, when some armed people attack dem and shoot gun for the gate.

" Dem shoot for the gate and scatter plenty vehicles,” Tanko tok, as e add say their lives dey for danger.

E describe the incident as attempted assassination and say, “democracy dey for danger.”

Obidient Movement bin dey the formal declaration of Olumide Akpata into ADC when the attack happen.

Tanko accuse the attackers say dem wan stop ADC members make dem no participate for politics freely, but e no mention any group or suspect behind the violence.


Today's Weather

  • Lagos

    Light rain shower

    High: 32°C | Low: 26°C