Okada Riders Don Dey Come Back To Some Road Wey Dem Ban Dem

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Remember say for October, 2022. Lagos state goverment come out come yarn say dem no want make Okada dey do dia work for 10 LG, and 15 LCDAs inside the state.

Even the Commissioner for Transportation, Dr Frederic Oladeinde, tok say the state no go look back, ontop this waka wey dem wan do for the state.

Dem even arrange special taskforce wey go chook eye ontop this one to make sure say any okada person wey break the law dem go gbab eim and the okada. And dem fit arrest pipu wey dey enta that kind okada wey dey drive for places wey dem tell okada not to drive inside the state.

E come be like say the ginger wey the government put when dem start the ban for October don calm down. Because wen tori pipu wey dey Guardian carry waka go chook eye for different places wey dem tell okada pipu to stop work. Dem see say some okada pipu don come back those places.

Places like okada Orile, Mile 2- Badagry expressway, Oshodi-Apapa expressway, Second Rainbow, Ojota and Berger bus stops. Dem see plenti okada pipu don dey come back to those place.

When dem follow one Mr Emeka Mmaduka wey be one of the pipu wey dey enta the Okada yarn say why eim still dey enta Okada. Eim say na because e dey make am go eim shop without any stress. Dem still ask Oga Mmaduka if eim know say dem fit arrest am if dem catch the bike wey eim dey on top? Eim yarn say eim be sharp guy so dem no go fit catch am.

One of the Okada man wey be Yusuf wey follow dem tok, yarn say government no fit ban Okada and dem no give dem anoda work wey dem fit use chop. That na why Okada go dey come back to the road. And pipu like okada because e dey carry dem enta place wey moto or taxi no fit enta.

The director, of Press & Public Affairs Lagos State Taskforce, Gbadeyan Abdulraheem, tok on top the mata say dem never stop top dey catch okada inside Lagos oooo! and dem no plan to stop the ginger dey de, dey ginger to arrest okada pipu wey dey ride for the road wey government don tok say make dem no ride on top.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 28°C