Nigeria Air: Di Airplane Wey Dem Pay Ethopia to Use - MD

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Di Boeing 737-800 series aircraft wey Federal Government fly enta Abuja for di unveiling of Nigeria Air, na Ethiopia Airlines get am.

Captain Dayo bin tok dis one we eim bin stand for front of di senate committee on top Avaition mata to clear di tok tok wey dey fly up and down about di Airline wey di last administration launch before dia tenure expire.

He still added dat di airplane wey enta naija, dem neva register am and e just get clerance for a few days and dem return am to Ethopia.

On top dis one, he say di passenegrs bin Ethiopia Airline staff and dem follow di plane come Nigeria and still follow am go back Ethopia.

Captain Dayo wey get 40 years experience for airline operations tok say dem give am work for February 2022 to make sure say Nigeria Air go get all di certificate wey e go need to fly and no be to operate di airline. 
He still tok say Nigeria neva ready to to operate airline as dem no get terminal for international operations  
 


How una see di mata?
#chookmouth 


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 34°C | Low: 27°C