On Air Now

Oga Madam

Noon - 2:45pm

NANS say dem no dey protest for third mainland bridge

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?
National Association of Nigerian Students don come out don shout say na lie oooo dem no get any plan block the Third Mainland Bridge on Wednesday.

National Association of Nigerian Students don come out don shout say na lie oooo dem no get any plan block the Third Mainland Bridge on Wednesday.

NANS Vice President of External Affairs, Babatunde Afis, tell our sister station Nigeria Info say dem no plan any protests for today 21st September, 2022

Dis one dey come two days afta di student union block Murtala Muhammed Airport, so federal government go answer university lecturers.

Di lecturers don dey  strike since 14 February, sake of say dem no get enough facility for universities, and universities no dey enough moni. 

Students of federal government universities neva enta class for seven months.

NANS plan say dem go protest for Apapa Port Complex on Tuesday but dem no do am again.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 34°C | Low: 28°C