Naija Midfield Machine! Deco Help Turkish Club Climb Up

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

At just 22 years old, Nigerian baller Emmanuel Toyin, wey dem dey call "Deco," don show say e no come play for Turkey. Di Lagos boy dey shine for Sapanca Kurtköyspor as di midfield general wey help dem win di Amateur 1 League and waka go next level for Sam Lig.

Born on November 2, 2002, Deco don turn serious engine for di team. As defensive midfielder, im sabi hold ground well, break attack, and still sabi pass ball like pro. Im dey always dey where action dey hot, and im dey make sure say midfield balance well.

But no be only defense im sabi. For just 15 games, Deco score 2 goals and drop 7 assists. Di guy dey show say e fit defend and still contribute for attack. Anytime game tight, na im dem dey rely on to calm things down and start better play from back.

One of im coaches talk say, “Deco na our heartbeat. E no just dey tackle, e dey control game. Every team suppose get player like am.”

Na true talk. Di guy no just dey play, e dey lead. Whether na to ginger boys when match don tough, or to follow coach plan well, Deco dey always deliver. E help make di whole team dey play like one strong unit.

Now wey promotion don sure, Deco dey ready face bigger challenge for Sam Lig. From Lagos street ball to title winner for Turkey, im journey still dey start.

Emmanuel Toyin "Deco" don show say talent, hard work, and correct mindset fit carry pesin go anywhere. Football world suppose watch dis boy well. E dey come strong.


Today's Weather

  • Lagos

    Heavy Rain

    High: 28°C | Low: 24°C