
Labour Party don give Peter Obi 48 hours to comot from the party officially.
Dem give dis ultimatum because say Peter Obi dey follow one new political coalition wey wan try collect power from APC for 2027 election.
For one statement wey come out on Thursday from the party’s National Publicity Secretary, Obiora Ifoh, Labour Party talk say dem no get interest to join the coalition at all. Dem talk say people wey dey inside that group na just power hungry people wey no really send the masses.
Dem warn Nigerians make dem shine eye, say that slogan “A New Nigeria is Possible” na just wash — say e no fit work with people wey dem call “old, recycled, desperate, and frustrated politicians.”