On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

JURGEN KLOPP DOWNPLAY REAL MADRID LINK AFTER DEM SACK XABI ALONSO

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Jurgen Klopp don yan say e no dey carry matter wey dey link am with the empty Real Madrid job after dem surprise sack Xabi Alonso.

The former Liverpool oga talk say e really shock am as dem sack Alonso, but e make am clear say the matter no concern am at all.

Dem comot Alonso after just eight months for the job, even though say e win 24 out of 34 matches. E last game na Spanish Super Cup wey Barcelona beat dem, and report talk say wahala for dressing room with some big players help cause im exit.

Dem don appoint Álvaro Arbeloa as interim coach make e hold ground for now.

Klopp, wey now be Red Bull Head of Global Soccer, calm the gist about coming back to coaching. As e yarn for Servus TV, the 58-year-old talk say im phone dey ring, but “no be from Madrid.” E still hint say Alonso sack show say “something no just dey right” for the club.

E add say Real Madrid get mad expectations, and make am clear say the whole situation “no trigger anything” for am, as e totally rule himself out of the race.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C