On Air Now

Evening Oyoyo

6:00pm - Midnight

JAMB Don Open 2026 UTME Registration, Warn CBT Centres Make Dem No Do Mago Mago

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don open registration for 2026 Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME), wey go dey from January 26 reach February 28 for everywhere for Naija.

Registrar of Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB), Prof. Is-haq Oloyede, don advise candidates make dem register only for approved CBT centres or JAMB offices. E also tell dem make dem correct any biodata error with National Identity Management Commission (NIMC) before registration, as na only data wey come from NIMC JAMB go accept.

Dem don dey sell E-PIN  since January 19 and go end February 26.

Direct Entry registration go run from March 2 to April 25, and e go dey available for JAMB zonal and state offices.

Registration fee dey between ₦5,700 and ₦8,700, depending on category.

2026 UTME examination go hold from April 16 to April 25, while optional mock exam go take place on March 28.

JAMB don warn CBT centres make dem no involve themselves for mago mago, bribe or overcharging of candidates. The board talk say any centre wey break the rule go risk licence revocation and prosecution, while centre operators go also answer for any misconduct wey their staff do.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 31°C | Low: 26°C