On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

ISWAP Don Tok Say Na Dem Attack Kuje Prison

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

E neva reach 24hrs wey some unknown gun men carry different type of gun enta inside kuje prison, dem start to dey shoot and dey bomb different things for the prison, dem even release some of the boko haram pipu wey dey inside the prison.

As different security join bodi don start work to know who be the pipu wey get mind to everi gun go come release pipu for the prison.

Presido follow chook mouth tell all the security join bodi say belle no sweet am with the way this bad pipu carry waka enta the prison and security sabi pipu no even know how dem take plan the waka.

But e come be like say The Islamic State's West Africa Province (ISWAP) no want make the security pipu waste there time, as dem don release video wey show dem dey attack the prison for Kuje on top internet.

 

The video wey be 28 seconds show pipu dey shoot gun, and burn different moto wey dey for the prison.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C