On Air Now

Inside Life

2:45pm - 3:15pm

INEC Beg Traditional Rulers Make Dem Support 2027 Election, Warn Staff Make Dem No Take Side for Any Political Party

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

INEC don beg traditional rulers for South-East make dem support am make election come 2027 peaceful, clear, and make nobody rig am, while e still warn im workers make dem no join any party politics.

Na dis talk INEC Chairman, Prof. Joash Amupitan, talk when im go visit di Chairman of Enugu State Traditional Rulers Council, Igwe Samuel Ikechukwu Asadu, for Enugu. Di visit na part of di commission nationwide tour to check how things dey go before di election.Amupitany explain say di tour na to check how ready dem dey, see how workers dey prepared down to ward level, and make relationship strong with traditional rulers.Im beg traditional rulers make dem help tell people wey get right make dem go collect dia Permanent Voter Cards (PVCs), make dem stop make people dey lax to vote or sell dia vote, and make everybody promote peace and no-violence before, during and after di election.Amupitany talk say presidential and National Assembly election go happen on Jan. 16, 2027, while governorship and state House of Assembly election go hold on Feb. 6, 2027.im give voters assurance say every correct vote go count, add say INEC dey work with security agencies to protect voters, election workers and properties.For im own response, Asadu promise say traditional rulers go support INEC to make sure people go collect dia PVCs.For another separate meeting with INEC workers for Enugu, Amupitany warn staff make dem no carry party for head, make dem do dia work well and be accountable as election dey come.Im talk say election materials wey no be sensitive don dey come, dem don give contract to fix facilities, and dem still dey buy more Bimodal Voter Accreditation Systems (BVAS).Di INEC Chairman add say staff training go cover di new Electoral Act and rules for di 2027 election. Im still talk about how dem dey prepare for logistics, result management and security.Amupitany come talk again say di commission dey work to make staff welfare better, including to start di approved new salary structure from January 2026.Im talk say im sure sey if INEC, traditional rulers, security agencies and election workers join hand work together, di preparation for peaceful and free election go strong well well.

Comments

Add a comment

Today's Weather

  • Lagos

    Heavy Rain

    High: 31°C | Low: 26°C