On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

ICPC Don Carry Wiretapping Gear Comot for El-Rufai House for Abuja

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

The body wey dey stop corrupt people for awa obodo country don talk for court on Monday say dem don find one machine wey fit hear people yarns inside the former Governor of Kaduna state for Abuja.

With the affidavit wey dem swear for the High Court of Justice for Abuja, dem don talk say dem search El Rufai house on the 19th February and de see the machine wey dey hear people yarns with some other document wey concern protection matter. ICPC talk say the search happen for Mambila street, Aso Drive, Asokoro District, and him wife Madam Hadiza Isma El-Rufai and him son Mohammed follow dey there. The body wey know about this machine say the machine fit affect the whole country protection and the investigation wey dem dey do ontop oga El-Rufai. Inside the affidavit, ICPC talk say na the Magistrate court give dem the document wey allow dem search and hold down the former governor for 14days and the document power go end this week.The body wey hold am down don say dem just hold am down like that for some time, dem say dem just ask am to come because of the matter wey dem don talk against am for him kurukere waka.Dem follow talk say make the High court comot El Rufai matter for their court as e dey affect him arrest and him fundamental righ.  For the document wey dey before the court, the ICPC don bring plenty matter against am even the matter wey concern 1.4 million and kurukere waka of 2.1 billion payment from state revenue account and transfer of 428 million to account wey dem no know. ICPC follow tell the court say one of EL Rufai aid don comot for the country.The body follow talk say El Rufai no gri for those wey dey find out the matter as him no give dem chance to touch the machine. EL Rufai don follow talk him own matter, him talk say the search wey dem do no follow law but ICPC don talk say make the court comot him matter for their place make dem fit continue their investigation.


Today's Weather

  • Lagos

    Sunny intervals

    High: 32°C | Low: 26°C