On Air Now

Kulele Zone

3:15pm - 6:00pm

FG Order Make Dem Comot Abeokuta Prison Bcos of Dirty, Bad Condition.

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Federal Government don order Nigerian Correctional Service make dem move all inmates from Abeokuta prison within four weeks bcos di sanitary condition for di place bad well well.

Di order come from Permanent Secretary for Ministry of Interior, Dr. Magdalene Ajani, during public hearing wey independent investigative panel hold for Abuja on alleged corruption and other wahala against NCoS.

Ajani still give NCoS two weeks to submit report on all juvenile detention centres, condemn di way dem dey keep minors together with adults, and ask for update on di state of borstal facilities across Nigeria.

Di panel also call out Ilorin custodial centre for di way dem dey keep inmates wey be between 30 and 43 years inside borstal, describe am as unacceptable, and order make dem remove di inmates immediately.

Panel secretary, Ju Agomoh, talk say di investigation dey cover corruption matter, welfare of inmates and other system failures. She add say di probe start after di September 2024 suspension of Kirikiri prison officers over di preferential treatment wey dem give Idris Okuneye aka Bobrisky.


Today's Weather

  • Lagos

    Heavy rain shower

    High: 27°C | Low: 24°C