Edo Train Attack: Police Don Arrest One Suspect

You are viewing content from Wazobia FM Lagos. Would you like to make this your preferred location?

Police don arrest of di suspects wey attack Igueben train station for Edo State.

Di State Commissioner for Communications and Orientation, Chris Nehikhare, tell press for Benin City on Sunday.

He tok say gbege pipo kidnap 32 pipo but one of dem escape.

“Afta dem kidnap 32 pipo , Police, vigilante, and local hunters enta action begin search bushes wey dey for dat area. One of di pipo wey dem kidnap escape” he tok.

Di attack dey come 10 months afta terrorist attack for anoda train for Kaduna State.

Dem kill more than 12 pipo for 28 March 2022 attack and dem kidnap 20.


Today's Weather

  • Lagos

    Thundery shower

    High: 35°C | Low: 27°C